Na beta news dey show so for Naija defenda Joseph Yobo as Norwich City wey dey ball for Premier League don confam say dem and hin club Fenerbache don chop knucle for de defenda mata.
Yobo wey waka lif Everton for 2012 don find shirt hard to find for Turkey and as e be so, na England hin go enta tap ball till dis seasin kpai.
De 33 years playa bin play Champions League for Fenerbache but lata tins come hard am, and as World Cup dey show de guyman dey luk am say hin supose begin dey play.
Tori wey comot for Fernebache offishal Twitter dem bin yarn say: "We dey yarn wit Norwich as per we playa Joseph Yobo wey go carri tap ball for Norwich till dis seasin kpai.
Norwich City manaja Chris Hughton sef confam am for press conference and e comot for dia website sef.
"City fit confam say wey dey arrange Joseph Yobo market wit Turkey club Fenerbache make we carri am come Carrow Road for loan."de statement yarn.
Yobo don play for Standard Liege and Olympique Marseille

No comments:
Post a Comment